25 And any family wey dey fight demsef, go skata.
Wen Josef brodas si sey dia papa like am pass dem, dem kon hate Josef and dey tok to am anyhow.
Make una si as e dey good and wonderful wen God pipol dey stay togeda for peace!
Any kingdom where pipol dey fight each oda, nor go fit stand.
So, if Satan kingdom divide against ensef, e nor go fit stand and en end don rish.
But if una kontinue to kworel among unasef; una go fit wound or kill each oda by mistake.
Bikos where jealousy and long-trot dey, wahala and bad tins wey pipol dey do, dey der too.