Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Mark 3:11 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

11 And anytime evil spirit wey dey inside some pipol body si Jesus, dem go fall for en front dey shaut, “Yu bi God Pikin.”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Mark 3:11
14 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Den di oda disciples for di boat kon bow down for Jesus front woship am sey, “True-true, yu bi God Pikin.”


Den devil kon meet am sey, “If yu bi God pikin, kommand dis stone make e turn to bread.”


and e tell Jesus, “If yu really bi God pikin, jump go down, bikos dem rite for God word sey, “ ‘God go kommand en angels make dem do evritin for yu and dem go katch yu make yor leg nor nak stone.’ ”


Di demons kon hala, “God Pikin, make yu leave us o-o, abi yu kom sofa us wen time neva rish?”


Den di demons beg Jesus, “If yu drive us komot, make yu send us go enter inside di pigs.”


Na so di gospel about Jesus Christ, God Pikin take start.


Demons dey shaut dey komot from many pipol body, dey sey, “Yu bi God Pikin!” But Jesus warn dem make dem nor tok, bikos dem know sey, naim bi di Mezaya.


Wen e si Jesus, e fall for en front kon shaut, “Make yu leave mi! Jesus, God Pikin, Abeg yu, nor ponish mi!”


Di girl kon dey follow mi and Paul for back dey shaut sey, “Dis pipol na God savants o-o, dem dey prish to una about how una go take save.”


But if anybody really dey hongry, make e chop kom from en house. Den wen una dey togeda, una nor go kondemn unasef. So wen I kom, I go tell una oda tins wey una suppose know.


Yu bilive sey na only one good God dey. Demons bilive so too and fear dey katch dem well-well.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ