Jesus kon dey waka for Galilee dey tish inside dia sinagog. E prish about God Kingdom and dey heal pipol wey get difren-difren diziz and doz wey nor well.
Anywhere wey Jesus go, weda na village or town or farm, dem go karry di pipol wey nor well for dia market place kon ask Jesus weda dem go fit tosh en klot and evribody wey tosh am, kon well.