Wen di law tishas and di Farisee pipol si sey e dey chop with sinnas and tax kollectors, dem kon ask en disciples, “Why una oga dey chop with tax kollectors and sinnas?”
Den Jesus kom down with en apostles kon stand for groun wey level. Many disciples from Judea, Jerusalem and all di small towns wey near Tyre and Sidon gada kon hear am dey prish and e heal doz wey nor well