John kon tell am, “Tisha, wi si one man wey use yor name dey drive demon komot from inside pipol body and wi kon try to stop am, bikos e nor dey follow us waka.”
I tell una true word, di pesin wey bilive mi, go do di kind mirakle wey I dey do and e go even do di ones wey big pass dem, bikos I dey go meet my Papa.
E kontinue to dey shaut like dis for many days. So di tin vex Paul well-well, naim e turn face di girl kon tell di spirit, “I kommand yu with Jesus Christ name, komot for dis girl body!” At wons, di spirit komot from di girl body.
Bikos God don promote am make e dey en rite hand and e don receive di Holy Spirit wey en Papa promise and naw, e don pour di Holy Spirit for awa body, as una si am dey happen so.
Di Spirit dey give odas di pawa to do mirakle and e make some pipol profets and some dey fit know wen God Spirit dey among us. Odas dey tok with difren-difren language and some among us go tell una wetin di tins wey dem dey tok, mean.
So for di church, God first choose apostles, before profets and tishas. E still choose some wey dey do mirakle, odas wey dey heal sick pipol, some wey bi leaders and odas wey dey tok with difren-difren language.
Bikos if una dey tok with difren-difren language wey odas nor undastand, God go undastand wetin una dey tok, aldo know oda pesin go know wetin e mean. Tins wey una go dey tok about, na only di Spirit go fit undastand dem.