13 Dem go back go tell di rest pipol, but di pipol nor still bilive dem.
Wen dem si am, dem woship am, but some among dem kon dey doubt.
Wen dem hear sey Jesus don wake-up from deat and Mary Magdalin don si-am, dem nor bilive.
Den Jesus appear to di eleven disciples wen dem dey chop. E shaut give dem since dem nor bilive, bikos of dia strong heart.
“Abraham ansa am, ‘If dem nor gri listin to Moses and di profets, dem nor go still listin, even if pesin wey don die go back go meet dem.’ ”
But dia word nor mean anytin to di apostles, so dem nor bilive di wimen.
And as dem neva still bilive (bikos of dia happiness) and still dey sopraiz, Jesus ask dem, “Una get anytin to chop for here?”
Di oda disciples kon tell am, “Wi don si Jesus.” But e ansa dem, “Unless I si en two hand wey dem nail kon put my finger inside di whole wey di nail make and shuk my hand inside di whole wey dey en belle, I nor go ever bilive una.”
Den John kon enter inside and wetin e si kon make am bilive.