Josef buy linen klot, bring Jesus body kom down from di cross kon take di klot wrap am, den e put am for grave wey dem dig inside rock. Den e roll big stone kover di grave mout.
Afta dis time, Josef wey kom from Arimatea, wey bi Jesus sekret disciple, (bikos e dey fear di oda Jew oga dem), kon ask Pilate make e allow am karry Jesus dead body komot for der. Pilate gri for am and e go karry Jesus body komot.