43 Josef wey kom from Arimatea, wey bi Jew kansol memba, wey dey wait for God Kingdom and pipol dey respet am well-well, go meet Pilate kon ask for Jesus body.
One man dey Jerusalem wey en name bi Simeon and di Holy Spirit dey inside am. Di man dey fear God and dey do wetin God like and e dey wait for di time wen God go free Israel.
For dat time, e kom meet Josef, Mary, di pikin and Simeon kon bigin tank God, dey tok about di pikin give evribody wey dey wait for di time wen God go free Jerusalem.
E get one man for di kansol, wey bi Josef and e kom from Arimatea wey dey Judea. E bi betta pesin wey dey do wetin God like and e dey wait for di time wen God Kingdom go kom.
Afta dis time, Josef wey kom from Arimatea, wey bi Jesus sekret disciple, (bikos e dey fear di oda Jew oga dem), kon ask Pilate make e allow am karry Jesus dead body komot for der. Pilate gri for am and e go karry Jesus body komot.
But di Jew pipol tok bad tins about Paul and Banabas give all di big wimen wey dey fear God and di big-big men for di town, so dem sofa dem and drive dem komot from di aria.
and bikos of di prison wey dem put mi so, almost all di brodas and sistas faith for Christ, don strong well-well. And naw, dem don dey prish God word without fear.