37 But Jesus shaut again, den e kon die.
So Jesus Christ kry again, den e kon die.
Den one pesin run kom with foam kon soak am inside betta wine, den e put am for stik give Jesus make e drink, den e kon sey, “Make una leave am! Make wi si weda Elijah go kom save am.”
So, Jesus shaut, “Papa, I put my spirit for yor hand!” Afta e tok finish, e kon die.
Wen e don taste di wine, Jesus kon sey, “Evritin don finish.” Den e bend en head down, kon die.
Wen Jesus still dey dis eart, e pray and kry to God wey go save am from deat. God hear en prayers, bikos e obey God for evritin.