As dem dey take Jesus komot, dem kon katch one man wey dey kom from Sirene and en name na Simon. Dem put di cross for en back make e karry am follow Jesus.
Dis na di profets and tishas wey dey di church for Antiok: Banabas, Simeon wey dem dey koll Naija, Lucius wey kom from Sirene, Manaen (wey bi Herod di Tetrak friend from small pikin) and Saul.
But some men kon dey argue with am. Dis men dey woship God for one place wey dem dey koll “Di Freedmen Sinagog.” Some among dem kom from Alexandria, Sirene, Silisia and Asia.