Pipol wey just hate mi wen e bi sey I nor do dem anytin, many pass di hair wey dey my head. Doz my enemies wey won distroy mi without any rizin, too plenty to kount. Dem dey make mi pay for wetin I nor tif!
As Pilate sidan for di judgement seat, en wife send message go meet am sey, “Nor put hand for dat innocent man matter, bikos last nite, I dream bad dream about am.”
Wen di sojas oga and di pipol wey dey guide Jesus Christ si di eartkweke and wetin happen, dem fear well-well kon sey, “True-true dis man na God Pikin.”
Bikos Pilate one do wetin di pipol wont, e kon free Barabas for dem, den afta e tell en sojas make dem flog Jesus, e kon give Jesus to di pipol make dem go kill-am.
Wen di priest oga dem and di temple polish dem si am, dem kon dey shaut, “Nail am for cross! Nail am for cross!” Den Pilate sey, “Make only una go nail am. But as for mi, I nor si any bad tin wey e do.”
Na Jesus bi di High Priest wey wi nid. E nor dey do bad tin; e dey holy; nor dey make mistake and e nor bi like wi, wey bi sinnas. God praiz am pass evritin wey dey heaven