68 But Pita deny kon sey, “I nor even know wetin yu dey tok about!” Den e waka go di gate and fawol kon do, “Kukuruku!”
Pita follow Jesus from far till e rish di High Priest varanda. E sidan with di guards dey warm en body near fire.
Wen di savant girl si am, e kon dey tell di pipol wey stand der sey, “Dis man dey among dem.”
But e deny again. Small time, di pipol wey stand for korna kon tell Pita, “True-true, yu dey among dem, bikos na Galilee yu from kom.”
At wons, fawol kon do, “Kukuruku!” di sekond time. So Pita kon remember wetin Jesus tell am: “Before fawol go do ‘Kukuruku!’ two times, yu go deny mi three times.” Den Pita kon bigin kry well-well.