As Haman still knee down near Estha dey beg am, di king kon waka enter from di gardin. As di king si am, e kon sey, “So yu even won rape my wife, di kween for my present?” As di king still dey tok, dem kon kover Haman face.
God tell Moses, “If to sey na en papa just spit for en face, dem nor go disgrace am for seven days? So make e komot form di kamp for seven days and afta, e fit kom back.”
Make wi dey look Jesus Christ wey give us awa faith and go help us keep am. Bikos of di joy wey Jesus dey espect, e sofa for cross and nor mind di shame wey follow am. But naw, e don sidan for di rite hand side for God throne.