55 Di priest oga dem and di Sanhedrin dey find wetin dem go take akuiz Jesus, so dat dem go fit kill-am, but dem nor si anytin.
Make una arrange two jaguda make dem akuiz am sey, e curse God and di king. Den take am komot for di town kon stone am die.”
Leta, di two jaguda kon akuiz Nabot sey, e curse God and di king, so dem take am go outside di town kon stone am die.
Nor let mi fall enter dia hand, bikos dem dey akuiz mi for wetin I nor do and dem always dey treaten mi.
Wiked pipol dey lie for my head. Dem dey akuiz mi about bad tins wey I nor do.
So di oda two men and di govnors kon dey find how dem go take trap Daniel, but dem nor si, bikos all wetin Daniel dey do, dey rite.
But I tell una, anybody wey vex for en broda, God go judge am too. Anybody wey curse en broda, go face di kansol and anybody wey koll pesin, ‘Mumu’, go-go hell-fire.
Many pipol lie for Jesus head and dem dey tok difren-difren tins, but dia story nor gri with each oda.
As dem dey der, di High Priest bigin dey ask Jesus kweshon about en disciples and wetin e tish.
Why yu dey ask mi? Make yu ask di pipol wey hear mi. Dem know wetin I tok.”