50 Den all en disciples kon run leave am.
Pipol wey I love and wey bi my friends, dey run from mi, bikos dem dey fear my diziz. Even my own family membas stand for far dey look mi.
Yu don allow pipol wey I love and doz wey love mi, dey run from mi. So, na darkness bi my best friend naw.
God ansa, “I mash di nashons like grapes by mysef. I use my vexnashon mash dem and na dia blood stain my klot so.
Jesus kon tell en disciples, “Una go run leave mi, bikos God word sey, “ ‘I go kill di pesin wey dey look di sheep and di sheep go skata.’
I dey with una evriday for di temple dey tish, but una nor arrest mi den.” Dis tin happen so dat wetin dem rite for God word, go bi true.
One yong man wey tie small klot for waist, dey follow Jesus. So dem won kon arrest di man join,
Look, di time dey kom and e don even rish, wen una go skata and evribody go-go en own way and I go stay alone. But I nor dey alone, bikos my Papa dey with mi.
Jesus kon sey, “I don tell una sey na mi bi di pesin. Since na mi una dey find, make una allow dis men go.”
Di first time wen dem karry mi go kourt, evribody abandon mi and all of dem run leave mi. Make God nor judge dem bikos of wetin dem do!