For aftanoon, Elijah kon dey laf dem dey sey, “Make una shaut well-well. Afta all, na god e bi, may bi e dey tink or waka go out or travel. May bi e dey sleep and e nid pesin wey go wake-am up.”
Wen Profet Mikaya rish where King Ahab dey, di king ask am, “Profet Mikaya, ‘Make mi and King Jehoshafat go attack Ramot for Gilead?’ ” Mikaya ansa, “Make una go attack am, bikos God go give una viktory.”
Elisha kon ask Israel king, “Wetin mi and yu get togeda? Make yu go meet yor papa and mama profets.” But Israel king ansa, “Nor tok like dat, bikos na God bring dis three kings togeda make Moab king and en pipol for kill us.”
Yong man, make yu happy as yu dey yong! Make yu enjoy evry minute for dis life and do evritin wey yu won do; but remember sey yu go tell God evritin wey yu dey do.
God wey get pawa sey, “Israel pipol, make una dey do wetin una like! Make una kontinue to serve una juju! But I dey warn una sey, afta una don serve juju finish, una go must obey mi kon stop to rijet my name wey dey holy, bikos una dey ofrin to juju.
Wen Jesus don tok all dis tins finish, e look heaven kon sey, “My Papa, di time don kom wen yu go give glory to yor pikin, so dat yor pikin go give yu glory too.
E get any profet wey una grand-grand papa dem nor kill? Dem even kill di messenja wey tok before sey, ‘Di Raitious Man go kom and una go gi-am to wiked pipol and dem go kill-am.’