39 E komot again, go pray as e pray before.
Wen una dey pray, make una nor tok one word many times as pipol wey dey serve juju dey do, bikos dem tink sey dia juju go hear dem wen dia tok plenty.
Make yu nor sleep, but dey pray make yu nor for fall enter temptashon. Man spirit won pray, but en body dey weak.”
Wen e kom back again, e si sey dem still dey sleep; dem nor dey pray, so dem nor know wetin to tell am.
Den Jesus tell dem one parabol to show sey, e good make pipol dey always pray.
Na three times I ask Christ sey, make e take dis tin komot from my body.
Wen Jesus still dey dis eart, e pray and kry to God wey go save am from deat. God hear en prayers, bikos e obey God for evritin.