27 Jesus kon tell en disciples, “Una go run leave mi, bikos God word sey, “ ‘I go kill di pesin wey dey look di sheep and di sheep go skata.’
God wey dey mighty sey, “Swod! Make yu go attack and kill di shepad wey dey work for mi, den all di sheep go skata. I go attack my pipol
God go bless di pesin wey nor dey vex for mi.”
Den Jesus kon tell dem, “Dis nite all of una go run leave mi, bikos God word sey, “ ‘I go kill di shepad and di sheep go skata.’
“I dey tell una all dis tins, so dat nobody go fit deceive una.
Look, di time dey kom and e don even rish, wen una go skata and evribody go-go en own way and I go stay alone. But I nor dey alone, bikos my Papa dey with mi.
Di first time wen dem karry mi go kourt, evribody abandon mi and all of dem run leave mi. Make God nor judge dem bikos of wetin dem do!