17 Wen evening rish, Jesus kon go di house with en twelf disciples.
So en disciples go di town and dem si evritin just as Jesus tell dem sey e go bi, dem kon prepare di Passova food for der.
As dem dey chop for di tabol, Jesus kon sey, “I tell una true word, one of una wey dey chop with mi, go sell mi give my enemies.”
Wen di time rish, Jesus sidan for where dem dey chop and en disciples kon join am.
“Wetin I dey tok so nor koncern all of una, bikos I know di pipol wey I choose. Dis show sey God word na true sey, ‘Di pesin wey follow mi chop don turn to my enemy.’