14 Di house wey e go enter, make una tell di pesin wey get am sey, ‘Di Tisha sey make wi ask, “Where di room wey mi and my disciples go for chop Passova food?” ’
As Jesus dey waka for road, one man run kom meet am sey, “Good Tisha, wetin I go do make I for get life wey nor dey end?”
If anybody ask una, ‘Why una dey luz am?’ Make una sey, ‘Di oga nid am naw. Wi go bring am back leta.’ ”
Jesus send two disciples go for front kon tell dem, “Wen una enter di town, una go si one man wey karry wota kontaina. Make una follow am.
E go show una one big room for upstair where tabol and chairs dey. Make una prepare evritin for der.”
make una tell di pesin wey get di house sey, Di Tisha sey make wi ask yu, ‘Where di room wey mi and my disciples go for chop di Passova food?’
Den Marta go meet Mary, en sista kon tok for en ear sey, “Di tisha dey here and e won si yu.”
Una dey koll mi ‘Tisha’ and ‘Oga God’, una korrect, bikos na so I bi.
Listin! I stand for di door dey nok! If anybody hear my vois, kon open di door, I go enter go meet am, kon follow am chop and e go chop with mi too.