Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Mark 13:22 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

22 Bikos fake christs and profets go kom and dem go do signs and mirakles wey bi like majik to deceive pipol. If to sey e possibol, dem go deceive di pipol wey God don choose.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Mark 13:22
16 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Lie-lie messiahs and profets go kom do big-big mirakles take deceive pipol. If e possibol sef, dem go deceive pipol wey God choose.


“Make yu shine yor eye, bikos lie-lie profets go kom like sheep, but for inside dia heart, dem bi wiked animal wey dey kill.


Dat time, if anybody tell una, ‘Look! Make una si Jesus for here!’ or ‘Si am for der!’ make una nor bilive dem.


Make una take kare! I don tell una evritin before di time go rish.”


Many pipol go kom with my name sey, ‘Na mi bi Christ’ and dem go deceive many pipol.


So Jesus ask am, “If una nor si signs and wonders una nor go bilive mi?”


May bi una get profet or doz wey dey si wetin go happen among una and dem kon show una signs and wonders,


But God strong foundashon still stand and dem rite put sey, “God know en pipol and evribody wey bi Christ own, must stop to do evil.”


My shidren, di world don dey end and just as una hear sey, anti-Christ dey kom, make una know sey many anti-Christ don already kom. And dis show us sey di world go soon end.


Na from us dis pipol from komot, but dem nor really dey God family before, bikos if to sey dem dey, dem for stay with us. But dem live us, so dat evribody go know sey dem nor bi awa own.


Na dis tins I dey rite give una about pipol wey dey try to deceive una.


Evritin for dis eart go woship am, even doz wey dia name nor dey for God Lamb book wey get life.


Di beast wey yu si, dey before, but e nor dey again and e go soon raiz kom from di pit kon start to distroy. Den doz pipol for eart wey dia name nor dey for di Life Book, go fear di beast.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ