44 Bikos di oda pipol give dia ofrin from di plenty money wey dem get, but dis woman, as e poor rish, put evritin wey e get for life.”
Jesus kon koll en disciples sey, “I tell una true word, dis poor woman wey e husband don die put money wey pass di oda pipol own.
Dis woman don do wetin e fit do. E anoint my body to prepare mi for beri before di time go rish.
Di yonga one kon tell en papa, ‘Give mi my own share for awa propaty.’ So en papa kon gi-am.
But wen dis yor pikin kom back afta e don waste all yor money with ashawo, yu kon kill di melu wey fat pass for am!’
One woman dey among dem wey don dey mestrate for twelf years naw, bikos nobody fit heal am.
Wen una borrow pesin money, make una nor take en grindin stone as shorti, bikos dat na di only tin wey di family take dey chop.
But pesin wey get enough tins and e nor sorry for en broda or sista for Christ wey nor get at-all, na how God love go take dey inside am?