Dia leaders bi like lion wey dey happy for di animal wey e kill. Dem kill pipol, take all dia money kon kollect di propaty wey dem fit kollect and naw, many wimen nor get husband again, bikos of dis tin wey dem do so.
Wen dem wont pesin land, dem go dey find how dem go take seize am and wen dem wont pesin house too, dem dey take am by force. Dem dey opress, shit and take pipol propaty.
“But e go bad for una wey dey tish di law and una Farisee pipol, una wey dey pritend! Una klose door make pipol nor for fit enter God Kingdom! Unasef nor won enter and una nor won make odas enter.
E go bad for una wey dey tish di law and una Farisee pipol, una wey dey pritend! Una dey use long prayer shit wimen wey dia husband don die, bikos of dis, God go ponish una well-well.”
Bikos na dis pipol dey hide enter pipol house kon sleep with wimen wey nor get sense; wey dey sin well-well and wetin dey sweet dis wimen to do, na-im dey kontrol dem.