Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Mark 12:37 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

37 If David ensef koll Christ, ‘Oga God,’ how Christ go kon take bi en pikin again?” Di pipol wey gada kon dey listin to am with happiness.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Mark 12:37
14 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

“Si! Di woman wey neva sleep with man before go get belle and e go born boy and dem go koll am, ‘Emmanuel’ wey mean, ‘God dey with us.’ ”


For dat time, Jesus kon sey, “I praiz yu Papa, Oga God wey get heaven and eart, bikos yu hide dis tins from pipol wey get sense and doz wey know book well-well, but yu show dem to small shidren.


Blind pipol dey si, pipol wey nor fit waka dey waka, God dey cure leper, deaf pipol dey hear, pipol wey don die, dey wake-up and poor pipol dey hear di Good News.


“Wen di priest oga dem and di Farisee pipol hear Jesus parabols, dem kon know sey e dey tok about dem.


So dem kon dey try to arrest Jesus, but dem dey fear, bikos di pipol bilive sey na profet e bi.”


But dem nor get any shance, bikos pipol dey listin to wetin Jesus dey tish.


And for early morning, all di pipol dey go listin to am inside di temple.


For dis time, plenty pipol wey dey Judea hear sey Jesus dey for dia town, so dem kon gada, nor bi bikos of Jesus alone, but dem won si Lazarus too, di pesin wey die before, wey Jesus wake-up.


Awa grand-grand papa dem wey follow God waka before, na from dem dis pipol from kom. So I dey pray make dem praiz God wey dey rule evritin forever and ever! Amen.


Wi know sey God ways dey great well-well: Christ kom as human being; di Spirit show sey e dey free; angels si am wen e kom prish among Gentile pipol; pipol bilive am for di world and God karry am go heaven with glory.


My brodas and sistas, make una listin! God nor choose poor pipol for dis world sey, make dem rish for faith and inherit di kingdom wey E promise sey E go give doz wey love am?


“Mi, wey bi Christ, I don send my angel make e kom tell di pipol for di church di trut about dis tins. I kom from David family and na mi bi di brite Star wey dey shine for morning!”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ