31 Di sekond one na, ‘Make una love una neighbour as una love unasef.’ E nor get any kommandment wey big pass dis two.”
Make una nor opress or play una neighbour wayo. Make una nor make una worker wait until di next day, before una pay dem.
Make una nor revensh anybody or kontinue to dey hate di pesin, but make una love una neighbour as una love unasef. Na mi bi God.
Di sekond one bi like di first one: ‘Make pesin love en neighbour as e love ensef.’
Bikos of dis, make yu trit pipol as yu wont make dem trit yu, bikos na so dem rite am for di Profets and Moses Law.
Di man wey dey tish di law kon tell Jesus, “Na thru, Tisha. Yu dey korrect for wetin yu tok, na only God bi Oga God and know oda god dey apart from am.
Di man ansa, “Make yu love God yor Oga God with all yor heart, yor soul, yor pawa and mind, den love yor neighbour as yu love yorsef.”
Bikos if dem add di whole law togeda, dem go kon bi one kommandment wey sey, “Make yu love yor neighbour as yu love yorsef.”
God don kommand us sey: “If anybody love mi, make e love en broda and sista for Christ too.”