29 Jesus ansa am, “Na dis bi di kommandment wey big pass: ‘Make una listin, Israel pipol, di Oga God, awa God na one e bi.
bikos Yu big well-well and dey do wonderful tins. Na only Yu bi God,
My pikin, listin well-well and make my life bi ezample to yu.
“Anybody wey love en papa, mama and pikin pass mi, nor go fit bi my disciple.
Make una nor koll anybody for dis world ‘Papa’, bikos na only one real Papa una get and e dey for heaven.
Di man ansa, “Make yu love God yor Oga God with all yor heart, yor soul, yor pawa and mind, den love yor neighbour as yu love yorsef.”
Since na only one God dey, E dey for Jew and Gentile pipol, bikos of dia faith.
So, even if pipol dey offa food give juju, all of us know sey di juju dem nor get life, bikos na only one God dey.
Wi know sey pesin wey bi middo-man dey stand between two pipol, but na only one God dey.
Naw, Israel pipol, wetin di Oga una God wont from unasef? E wont make una dey fear am kon dey live di kind life wey E wont make una live. E wont make una love, respet and serve am with all una soul and heart.
Di Oga una God go sekonsaiz una and una shidren heart by ensef, so dat una go love am with all una heart and soul, den una go get betta life.
Israel pipol! Make una listin! Di Oga na awa God and God na one!
But di rizin why I dey give dis kommand, na bikos I love dem from my heart with betta mind and faith.
Bikos na only one God dey and na Jesus Christ wey kom as human being, bi di pesin wey dey bring God and human being togeda.
Yu bilive sey na only one good God dey. Demons bilive so too and fear dey katch dem well-well.
Make all glory, majesty, pawa and authority, bi God own, naw and forever thru Christ wey bi awa Oga God. Amen!