Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Mark 11:33 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

33 So dem ansa Jesus, “Wi nor know.” Den, Jesus sey, “Mi too nor go tell una who give mi di pawa to do all dis tins.”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Mark 11:33
26 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

E dey katch pipol wey feel sey na dem get sense pass kon end dia wayo work.


Melu know en owner, donkey sef know who dey gi-am food, but Israel wey bi my pipol nor know or undastand mi at-all.”


E sey, “All di leaders wey suppose warn my pipol, dey blind! Dem nor know anytin. Dem bi like dog wey nor dey bark; dem just liedan dey dream. Make una si as dem like sleep well-well!


My pipol don die finish bikos dem nor know mi. Since di priests don rijet mi, misef go rijet dem as my priests. Since una don forget una Oga God laws, misef go forget to bless una shidren.


Make una leave dem! Dem bi blind pipol wey dey show blind pipol road. If pesin wey blind dey show anoda blind pesin road, two of dem go fall inside gutta.”


Wiked and evil pipol for dis time dey ask for sign, but dem nor go get any one, escept Jonah sign.” Den Jesus kon waka leave dem.


So dem ansa Jesus, “Wi nor know.” Jesus kon tell dem, “Misef nor go tell una wish pawa I take dey do all dis tins.”


But wi nor fit sey, ‘Na from pipol.’ ” bikos wi dey fear dis pipol, (since dem bilive sey John na profet).


Jesus kon tok to dem with parabol: “One man plant grape for en farm. E fence am round, dig where dem go dey press di wine put, den kon build big house wey guide go dey stay. E hire am give tenants wey go dey kare for di farm kon travel go far.


Jesus ansa, “Yu bi tisha for Israel, yet yu nor fit undastand dis tins?


E kon ansa dem, “I don tell una before, but una nor gri. Why una won hear am again? Abi, una won bi en disciples too?”


Since dem nor gri put God for mind and serve am, E kon leave dem make dem use dia bad mind dey do tins wey dem nor suppose do.


So till today, anytime wey dem read wetin Moses rite, sometin dey kover dia mind,


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ