24 Na dis make mi dey tell una sey, anytin wey una pray and ask God for, make una bilive sey una don get am and e go bi una own.
“Again, I tell una true word, if two of una for dis world gri and pray for anytin, my Papa for heaven go do am for una.
If una bilive, una go get anytin wey una ask for, wen una pray.”
Anytime una dey pray, if una get anytin for mind against anybody, make una forgi-am, so dat una Papa wey dey heaven go forgive una too.
And anytin wey una use my name ask, I go do am, so dat pipol go honor di Papa bikos of en pikin.
If una stay inside mi and my word dey inside una, anytin wey una ask, I go do am for una.
So wen wi tok with difren-difren language wey odas nor undastand, make wi pray make God give us di pawa to esplain wetin e mean.
and anytin wey wi ask from am, E go give us, bikos wi dey do wetin E wont and na dis tins dey make belle sweet am.