Blind pipol dey si, pipol wey nor fit waka dey waka, God dey cure leper, deaf pipol dey hear, pipol wey don die, dey wake-up and poor pipol dey hear di Good News.
kon tell dem, “Anybody wey welkom dis small pikin bikos of mi, don welkom mi and anybody wey welkom mi, don welkom God wey send mi, bikos di pesin wey small pass among una, na-im big pass for God Kingdom.”
yu go open dia eyes make dem for waka komot from darkness enter lite. Make dem komot from Satan hand, go meet God, so dat God go forgive dem dia sins and dem go follow di pipol wey God don make klean, bikos dem bilive am.’