25 E go dey eazy for kamel to pass nidol whole, dan for pipol wey get money well-well to enter God Kingdom.”
Doz wey trust dia propaty, go fall like wetin harmattan breeze blow; but raitious pipol go prosper well-well, dem go bi like sun wey dey shine.
Black man fit shange en skin kolour, abi leopard fit komot di mark wey dey en body? If dem nor fit, den e go hard for wiked pesin to do good, bikos na only to do bad tins, e sabi.
Una wey bi oga wey blind! Una dey remove fly from una drink, but una dey swallow melu!
Dem sopraiz more-more kon dey ask each oda, “Den, who God go save?”
E dey eazy for kamel to pass nidol whole dan for pesin wey rish well-well to enter God Kingdom.”