So di news about Jesus kon spread go evriwhere for Siria. Dem kon bring pipol wey nor well, wey nor fit waka, pipol wey devil dey worry and di pipol wey demon dey inside dem, kom meet am and e heal all of dem.
Demons dey shaut dey komot from many pipol body, dey sey, “Yu bi God Pikin!” But Jesus warn dem make dem nor tok, bikos dem know sey, naim bi di Mezaya.