31 Jesus go meet am, hold en hand and di woman kon stand up. Den di fever komot from en body and e kon dey serve dem.
So, wetin I go give God for evritin wey E don do for mi?
Many wimen wey follow Jesus Christ from Galilee and wey dey help am, dey der too. Dem dey look wetin dey happen for der.
Simon wife mama nor well, so dem kon tell Jesus about am.
Wen sun don dey go down for evening, dem kon bring all di pipol wey nor well and wey get demon kom meet Jesus.
For di time wen Jesus dey Galilee, dis wimen dey follow and help am. Many oda wimen wey follow am kom from Jerusalem, dey der too.
Den e whole di pikin hand small-small kon tell am, “Talita kumi,” wey mean “Small girl, get up.”
Pita kon hold en hand stand up. E koll di bilivers and all di wimen wey dia husband don die, kon give di woman to dem.