Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Malakai 3:13 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

13 God sey, “Una don tok bad-bad tins against mi. But una dey ask, ‘Wetin wi tok?’

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Malakai 3:13
24 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

sotey yu dey tok all dis kind words, bikos yu dey vex for God?


Yu dey try to sey I dey wiked, bikos yu dey sey I dey wrong and yu dey rite?


Wiked pipol dey sey, “God nor dey si us! E don klose en eye and E nor go even fit si wetin wi dey do!”


But Fero ask dem, “Who bi dis God wey go make mi fear am kon let Israel pipol go? I nor know am, so I nor go let Israel pipol go.”


Yes! Jerusalem pipol own don finish and Judah town don dey fall! Evritin wey dem dey tok and do, dey make God vex, bikos dem dey oppoz God law.


“ ‘Who yu tink sey yu dey curse and laf since? Yu nor dey respet mi wey bi Israel God wey dey holy.


So, una wey sturbon and nor dey do di rite tin, make una listin to mi.


Dem dey sey, “Make God kwik do wetin E sey E go do, so dat wi go si. Make Israel God wey dey Holy do wetin E plan, so dat wi go know.”


But since wi stop to sakrifice and pour wine give Heaven Kween, wi nor get anytin again and war with honga don early kill awa pipol finish.”


Dem dey shame sey dem do dis kind wiked tins? ‘No!’ Dem nor dey shame at-all; dem nor even sabi form sef! Bikos of dis, just as pipol wey don die, na so too dem go die finish afta I don ponish dem.” Mi, wey bi God, don tok.


“Den una sey, ‘God dey play wayo.’ Naw, Israel pipol, make una ansa mi, ‘I dey play wayo?’


Dem dey always waka leave mi go meet and follow oda gods wey nor get pawa. Dem nor dey stabol; dem bi like bow wey bend. Bikos dia leaders dey tok anyhow, dia enemies go kill dem, den Egypt pipol go laf dem well-well.”


Una dey ask, “Why E nor gri asept awa sakrifice again?” Na bikos E know sey una don break di promise wey una make with di wife wey una marry wen una yong. Na una patina e bi, but naw, una don break di promise, even doh una promise for God present sey una go dey faithful to am.


Una don make God taya with una many tok. But una still dey ask, “How wi take make God taya?” Na wen una sey, “Pipol wey dey do bad tins, dey good for Oga God eye and E like dem well-well and wen una still ask sey, ‘Where di God wey dey judge well?’ ”


Den di pipol for di nashons go koll una, ‘Happiness’, bikos una land go bi betta place for pipol to stay.”


Una sey, ‘E nor get wetin pesin go gain if e serve God. Wetin bi di nid to do wetin E tok or try to show Oga God sey wi dey sorry for wetin wi do?’


E dey good for pesin to shit God? No! But una dey shit mi and una dey ask, ‘How wi take dey shit Yu?’ Na for di matter wey koncern una ofrin and one out of evry ten tins wey una get.


But, my friend, I dey ask, “Who yu tink sey yu bi, wey make yu dey ask God kweshon? Pot wey dem mold fit ask di pesin wey dey mold am sey, ‘Why yu dey mold mi like dis?’ ”


E go oppoz and karry ensef pass God and oda tins wey pipol dey woship. E go even sidan for God Temple dey tok sey e bi God.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ