Den I tink of all di wiked tins wey dey happen for dis world. I si pipol wey dem dey opress, dey kry and nobody dey to help dem. Nobody dey to save dem from doz pawaful men wey dey opress dem.
So, Jeremaya my profet! Make yu nor pray or beg mi bikos of dis pipol. Wen dem dey trobol, make dem nor koll mi for help, bikos I nor go listin to dem.”
Even if dem fast, I nor go listin to dia kry for help and if dem offa burnt and korn ofrin, I nor go asept am. Instead I go kill dem for war and with diziz and honga.”
Dia gift wey dem dey bring from Sheba or di incense wey dem bring from far land nor mean anytin to mi. I nor go fit asept dia ofrin again and dia sakrifice nor fit make belle sweet mi.’
God sey, “I wish sey one of una go klose di temple door, so dat una nor go dey burn yuzles fire for my altar. I nor dey happy with una and I nor go asept di sakrifice wey una dey bring kom give mi.”
Make una dey kareful, if not wiked tins go full una mind, den una nor go give pesin money, bikos di seven years don dey near. If una nor gri give di pesin money and di pesin kon kry give God, dat mean sey una don kommit sin.
Even wen wi dey mourn, wi nor chop any one; wen wi nor dey klean at-all, wi nor tosh am and wi neva offa any of am to dead body. Wi don obey di Oga awa God and wi don do evritin wey Yu kommand us.