Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Malakai 1:7 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

7 Dis na how una nor take dey respet mi: una dey offa yuzles food for my altar, yet una still dey ask, ‘How wi nor take dey honor yor name?’ I go tell una. Una sakrifice show sey una nor dey respet my altar at-all.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Malakai 1:7
14 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

For di road wey dem dey pass enter di Most Holy Place, e get sometin for der wey bi like altar wey dem do with wood. E high pass five fit and almost wide rish four fit. En korna; di base and en sides, na wood dem take make dem. Den di man tell mi, “Dis na di tabol wey dey God present.”


Na only dem go enter my temple; serve mi for my altar kon lead odas to woship mi.


“ ‘Make una nor give God korn ofrin wey dem make with yist; una must nor make di food ofrin wey una go give God with yist or honey.


Dem must dey holy to dia God and nor disgrace my name, bikos na dem dey offa food ofrin to mi.


Di pipol must si di priest as pesin wey dey holy, bikos na-im dey give di food ofrin to mi. I dey holy and I dey make my pipol holy.


Di priest go burn dem for di altar as food ofrin to God.


But una nor dey respet mi, bikos una sey e dey okay to spoil God altar, so una dey give mi sakrifice wey unasef nor go asept.


Una sey, ‘Si! E too hard to serve God!’ So una nor gri obey my kommand again. Naw, make una tink am sef, e good as una dey bring animal wey una tif; di ones wey dia leg break or wey dey sick, kom give mi as sakrifice? Una tink sey I go asept am from una?


Una tink sey e nor dey bad to offa animal wey blind and dey sick as sakrifice to mi? Make una try give dat kind animal to una govnor, weda e go happy or give una anytin wey una ask from am.


Yu nor fit drink from God cup and demon cup for di same time.


But if di first pikin for di animal get problem like sey e nor fit waka or e blind or if any oda tin dey happen to am, make una nor sakrifice am give di Oga una God.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ