and Oga God kon tell am, “Na two nashons dey yor belle and two pipol go kom out from inside yu. One go dey strong pass di oda one and di senior one, go serve di yonga one.”
But I don naked Esau shidren-shidren finish kon open where dem hide put, so dat dem nor go fit hide again. Dem don distroy Edom pipol and nobody among dem remain.
So make yu listin to di plan wey I get for Edom pipol and wetin I won do to di pipol wey dey Teman town. Dem go drag dia shidren go and I go distroy di land finish bikos of di tins dem do.
Dis na wetin God wey mighty tok about Edom: “Teman pipol nor sabi judge well again? Who dey advise Edom nor fit tell dem wetin dem go do? Abi all dia sense and wisdom don vanish?
Jerusalem pipol, God nor go ponish una again, instead E go take una komot from Babilon go back to una own land. But una wey kom from Edom, make una nor worry, God go ponish una, bikos of una sins.