Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Malakai 1:13 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

13 Una sey, ‘Si! E too hard to serve God!’ So una nor gri obey my kommand again. Naw, make una tink am sef, e good as una dey bring animal wey una tif; di ones wey dia leg break or wey dey sick, kom give mi as sakrifice? Una tink sey I go asept am from una?

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Malakai 1:13
28 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

But di king ansa, “No! I nor go fit give di Oga my God, sakrifice wey I nor pay anytin for.” So e buy di farm and di melu for fifty silva koins.


Who sey make una dey bring dis animals wen una dey kom woship mi? Who sey make una dey mash round my temple?


Una take smooth stones from der kon dey woship am as god. Una pour wine put kon give dem rice as ofrin. So, una tink sey I dey happy with all dis tins wey una dey do?


God sey, “I like betta judgement, but I hate opreshon and wahala. I go dey faithful to reward my pipol and make kovenant wey go last with dem.


But I ansa, “God wey get pawa well-well, make Yu nor do am like dat! Since I small, I neva chop food wey di law dey forbid or chop animal wey die on en own or wey wiked animal kill. I neva chop any food wey nor klean.”


Di priests nor go chop bird or animal wey die on dia own or wey anoda animal kill.”


Israel pipol, mi wey bi una only helpa go soon distroy una.


E nor go chop any animal wey die on en own or wey anoda big animal kill, bikos e go make am unklean. Na mi bi di Oga una God.


If any man kommit dis kind sin, evritin wey e get thru wayo or lie-lie, e go must riton dem.


Una dey tell unasef sey, “Wen di new moon festival go end sef, so dat wi go fit go sell awa korn? Na wen Sabat go end, make wi for fit sell again? Wi nor fit wait to shit awa customers, use wayo take measure tins, so dat wi go get more money.


My pipol, wetin I do una? Wetin I do wey make una taya for mi? Make una ansa mi naw!


God sey, “I wish sey one of una go klose di temple door, so dat una nor go dey burn yuzles fire for my altar. I nor dey happy with una and I nor go asept di sakrifice wey una dey bring kom give mi.”


Doz wey do dis kind tin, make God wey get pawa remove dem komot from Israel kommunity and make E nor ever let dem join again for di sakrifice wey awa pipol dey bring kom gi-am.


Dis na anoda tin wey una dey do: Una go kry until una tear go full God altar, bikos E nor asept di sakrifice wey una bring kon gi-am.


“Wen una dey fast, make una nor skwiz una face like pipol wey dey pritend, so dat pipol go si sey dem dey fast. I tell una true word, dem don already get dia full reward.


“Anytime wey una dey pray, make una nor do like pipol wey dey pritend, wey like to dey stand pray inside sinagog and for road, so dat pipol go si dem. I tell una true word, dem don already get dia reward.


But if di first pikin for di animal get problem like sey e nor fit waka or e blind or if any oda tin dey happen to am, make una nor sakrifice am give di Oga una God.


So wetin make dem get long-trot for di sakrifice and ofrin wey I sey make dem put for where I dey? Eli, yu don honor yor boys pass mi, bikos yu don make dem fat from di best part of meat from all di ofrin wey my pipol for Israel dey bring.’


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ