For di road wey dem dey pass enter di Most Holy Place, e get sometin for der wey bi like altar wey dem do with wood. E high pass five fit and almost wide rish four fit. En korna; di base and en sides, na wood dem take make dem. Den di man tell mi, “Dis na di tabol wey dey God present.”
Dem dey mash poor pipol head for san-san kon push doz wey nor get who go help dem komot for road. Papa and pikin dey sleep with di same woman and like dis, dem don spoil my name wey dey holy.
Una sey, ‘Si! E too hard to serve God!’ So una nor gri obey my kommand again. Naw, make una tink am sef, e good as una dey bring animal wey una tif; di ones wey dia leg break or wey dey sick, kom give mi as sakrifice? Una tink sey I go asept am from una?
But una wey bi priest don turn komot from di korrect road. Wetin una dey tish naw, don make many pipol dey sin. Una don break di kovenant wey I make with una.