Some wimen wey dia pipol don die, na faith make dem receive dem back, alive. Some pipol rijet freedom kon die for sofa, so dat dem go fit wake-up from deat and enter life wey betta pass dis one.
Make yu nor fear di tins wey yu go soon sofa. Devil go trow some of una inside prison, so dat e go test una. Yu go sofa for ten days. But make yu nor live mi, even if e mean sey yu go die. Bikos I go give yu di crown wey bi life.