Anytime dem sofa una for one town bikos of mi, make una run go anoda town. I tell una true word, una nor go run pass all di town for Israel, before Man Pikin go kom back.
Jesus tell dem, “I know sey una go kwote proverb for mi sey, ‘Doctor, make yu cure yorsef!’ And una go sey, ‘For here wey bi yor home-town, wi won make yu do wetin wi hear sey yu do for Kapanaum.’ ”
But di Jew pipol tok bad tins about Paul and Banabas give all di big wimen wey dey fear God and di big-big men for di town, so dem sofa dem and drive dem komot from di aria.