Na so dis tins go bi until God go from heaven kon give us new life, den di desert go turn where fruit dey and di fruit tree go many like sey na forest.
But di pesin wey go help una na di Holy Spirit, wey my Papa go send kom for my name. E go tish una evritin and e go help una remember evritin wey I don tell una.
Den wen e follow dem sidan dey tok, e kon kommand dem sey, “Make una nor leave Jerusalem, but make una wait for di tin wey my Papa promise wey I don tell una before.
but una go get pawa wen di Holy Spirit don enter una life and una go tell pipol about mi for Jerusalem, for evriwhere for Judea and Samaria go rish all di far place wey dey dis world.”