46 So, Jesus shaut, “Papa, I put my spirit for yor hand!” Afta e tok finish, e kon die.
I don put my life for yor hand. So Oga God, make Yu diliver mi, bikos Yu bi God wey dey faithful.
By den, yor body go-go back to groun where e from kom, while di spirit go-go back go meet God wey bin gi-am to yu.
Wen e don taste di wine, Jesus kon sey, “Evritin don finish.” Den e bend en head down, kon die.
As dem dey stone Stefen, e kon pray, “Oga God, Jesus Christ, make yu receive my spirit.”
Wen Jesus still dey dis eart, e pray and kry to God wey go save am from deat. God hear en prayers, bikos e obey God for evritin.
Wen dem curse am, e nor ansa back; wen e sofa, e nor treaten sey e go pay dem back, but e put ensef for God hand wey nor dey judge kase with parsha.