But wen e si all di good tins wey en sofa bring, belle go sweet am. My savant wey I like well-well, go bear plenty pipol ponishment and I go forgive dem bikos of am.
E nor get anoda god like Yu; Yu dey forgive yor pipol wey survive. Yu nor dey vex forever, instead, Yu dey happy to show yor pipol yor love wey nor dey end.
Papa, I wont make di pipol wey yu give mi stay with mi for where I dey, so dat dem go si di glory wey yu give mi, bikos yu love mi before yu kreate di world.
Pesin wey get ear, make e hear wetin di Spirit dey tell di pipol for di church. Anybody wey fit bear rish di end, I go allow am chop from di tree for God Paradise and dis tree dey give life.’ ”