37 den sey, “If yu bi di Jew pipol king, make yu save yorsef!”
“E save oda pipol, but e nor fit save ensef! If e kom down naw from di cross, wi go bilive sey, na-im bi Israel King!
Since e trust God, make God kon save am naw, bikos e sey, ‘I bi God Pikin!’ ”
Dem kon rite sey, “Dis na Jew pipol king.”
One of di tif dey shaut for Jesus, “Nor bi yu bi di Mezaya? Make yu save yorsef and us naw!”