45 Wen e pray finish, e go meet en disciples kon si sey dem dey sleep, bikos dem don taya well-well.
Wen Jesus kom back, e kon si sey all en disciples dey sleep. Den e ask Pita, “So yu nor fit stay make yu nor sleep for one hour?
E kom back kon si en disciples dey sleep again; dem nor fit open dia eyes.
Wen Jesus kom back, e meet en disciples dey sleep, so e tell Pita, “Simon, yu dey sleep? Yu nor fit stay make yu nor sleep for one hour?
Bikos Jesus dey struggol well-well for mind, e pray sotey en sweat kon bi like blood.
So Jesus tell dem, “Why una dey sleep? Make una get up pray, so dat una nor go fall enter temptashon!”