As I still dey look for di vishon for nite, I si wetin bi like human being. E dey waka kom with kloud wey dey round am, den e go show ensef give di Pesin wey dey live forever.
“Den Man Pikin sign go appear for heaven and all di tribes for dis world, go kry. Dem go si God Pikin dey kom from inside di kloud for heaven with pawa and betta glory.
Pipol go dey faint and fear go dey katch some, bikos of wetin dey happen for di world and difren pawas inside di sky, go shake komot for where dem dey.
(Make una look! E dey kom back inside di kloud and evry eye go si am. Even doz wey shuk am and all di tribes wey dey dis eart, go kry bikos of am. Dis tins go really happen! Amen.)