15 bikos I go give una di word wey una go tok and wisdom wey una enemy nor go fit oppoz.
Na God dey give wisdom! Na from en mout knowledge and undastandin dey from kom.
So God stresh en hand kon tosh my mout, den E sey, “Make yu listin, na mi go tell yu wetin yu go tok.
“Wen dis tins happen, I go make Israel pipol strong and yu, Ezekiel, go tok for where evribody go hear yu, so dat dem go know sey na mi bi God.”
bikos di Holy Spirit go tell una wetin to tok, wen dat time rish.”
Una papa, mama, brodas, rilashons and friends go sey dem nor know una and dem go even kill some of una.
Den e open dia mind so dat dem go fit undastand God word
Den di Holy Spirit enter dia body and as di Spirit give dem pawa, dem kon start to tok for difren language.
Fear katch Felix, as Paul dey tok about di Good News, sef kontrol and how God judgement go take kom, so e kon tell Paul, “Make yu go first, wen I get time, I go sey make dem bring yu kom again.”
Agrippa ask Paul, “So yu tink sey just naw-naw, yu fit turn mi to Christian?”
But dis pipol nor fit stand di wisdom and pawa wey Stefen take dey tok.
Make una pray for mi too sey, make God give mi betta word anytime wen I open my mout to tok and make I fit esplain di sekret wey dey di gospel.
But if anybody nid wisdom, make e ask God wey dey gi-am to evribody. E nor go sey, “No,” but E go give yu.