31 If anybody ask una, ‘Why una dey luz am?’ Make una ansa, ‘Di oga nid am.’ ”
Na God get di eart and evritin wey dey inside. Di world and evribody wey dey stay inside, na en own too.
“Make una go di village wey dey front. Wen una enter, una go si one small donkey wey nobody don sidan put before, wey dem tie for der. Make una luz am kom give mi.
So di pipol wey dem send go, kon rish di place wey Jesus tell dem.
Una know di message wey E send to Israel pipol, wen E tok about di Good News wey dey give peace, thru Jesus Christ, di real Oga God.