15 “Wen e kom back afta e don get di kingdom, e kon koll en savants wey e give money make e for know how mush dem don gain.
“Afta, dia oga kon kom back make e for know how dem use di money wey e give dem.
But di savant wey nor know wetin en oga wont and e do tins wey go make dem flog am, dem go flog am small. Pesin wey God give plenty tins to, E go ask plenty tins from am and di ones wey God give plenty, E go ask doubol from dem.”
“But e own pipol nor like am, so dem kon send message follow am sey, ‘Wi nor wont dis man to bi awa king!’
“So di first one stand for en front sey, ‘Oga God, I don gain ten koins join di ones wey yu give mi.’