Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Luke 13:4 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

4 Doz eighteen pipol wey die wen towa fall for dia head for Siloam, una tink sey na dia sin big pass for Jerusalem?

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Luke 13:4
13 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Doz wey survive run enter Afek town where di town wall fall press and kill 27,000. King Ben-Hadad still run enter di town and e hide for di back room for one house.


Shallum pikin, Kol-Hozeh, wey bi ruler for Mizpa aria, ripair di Well Gate. E ribuild and roof am, kon fix di doors, en bolts and bars. For Siloam Pool, near di royal gardin, e still ripair di wall go rish di road wey lead to David Town.


den one kind strong breeze from di wildaness blow di house fall kon kill all of dem. Naw, na only mi one eskape kom tell yu.”


“Bikos dis pipol rijet Shiloah kwayet wota wey dey flow pass, but dey fear wons dem si Rezin and Pekah,


As di king dey shek di akkount, dem kon bring one savant wey dey whole 10,000 koins kom.


forgive us all di bad-bad tins wey wi don do, as wisef dey forgive odas di bad tins wey dem do us.


Make yu forgive us awa sins, as wi dey forgive doz wey do us bad. Nor let us enter temptashon.’ ”


I tell una true word, nor bi so e bi! Unless una turn from sin kom meet God, all of una go die too!


I tell una true word, nor bi so e bi! Unless una turn from sin kom meet God, all of una go die too!”


E ansa dem, “Na di man wey dem dey koll Jesus take san-san wey e spit put rub my eye. Den e tell mi sey, ‘Make yu go Siloam go wosh yor face.’ Afta I go wosh my face for di pond, I kon bigin si.”


Den e tell am, Make yu go wosh yor face inside di pond wey dem dey koll Siloam (dis name mean ‘Send’).” So di blind man kon go wosh en face as Jesus tell am. As e dey kom back, e kon bigin si.


Wen di pipol wey dey stay der si sey di snake put e mout for Paul hand, dem kon dey tell demsef, “E bi like sey dis man hand nor klean! Even doh e nor die inside sea, hand don still tosh am for here!”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ